Joint security team don kill 5 suspected criminals for Anambra State.
Di team wey gather police, military and other security agencies enter di criminals camp where them de operate go ambush them.
Di Anambra State Police Command spokesperson, SP Tochukwu Ikenga give this update during one press statement to some journalists for Awka, di state capital city.
Ikenga talk sey di incident happen on Monday, January 13 around 12:30 pm for Umuogem, Ufuma, Orumba North Local Government Area, Anambra State.
During di operation, members of di security team kill 5 members of di ganga while some manage escape with bullet wounds.
4 Undetonated IEDs Recovered from Criminal Camp
Di command spokesperson also talk sey, as them burst down di criminal camp, them recover some weapons wey di gangs dey use operate.
Amongst di weapons na 2 AK 47, 1 pump action gun and others.
“During di operation, di security team recover 4 undetonated improvised explosive devices (IED), 2 AK 47 assault riffles, 1 pump action gun and 1 75-volt battery and other items” Ikenga talk so.
Di SP still talk sey di reason wey them succeed with di operation na because di various security agencies join head do am.
Him talk sey, commissioner of police, CP Nnaghe Obono Itam de call for cooperation of di people in that area as them still de continue with di operation.