Fresh attack: Bandits kill 21 in Katsina State

Nigerianbandits Fresh attack: Bandits kill 21 in Katsina State

Public Relations Officer for Katsina State Police Command, DSP Abubakar Sadiq don confirm sey bandits attack and kill 21 members of Katsina State Community Watch Corps and Vigilante wey go for condolence visit to do family of one of their members wey them don kill before.

Di DSP talk sey, “21 people die for di attack. We de currently make eforts to find di people wey do this terrible thing”.

Resident debunks news of condolence visit

As di investigation still de go on, one resident of Baure don comot talk sey no be condolence visit di 21 vigilante members go. Him explain sey di vigilante members been de try fight do bandits.

Baure don dey highjacked by bandits for some time now”.
Baure na one of di villages wey bandits de disturb for inside Safana Local Government Area of Katsina State.

Di resident talk sey, “No be true sey na condolence visit to one of their members’ family. No security dey Baure, anyone wey de live for Baure dey in di hands of bandits.

Bandits de come do market steadily and di joint security team been try confront them. Unfortunately di bandits don already get information sey di joint security de come.

Them come call for more of their members come over power di joint security team. Na why them killany people be that.

People wey die pass 20 and others get injury. Na during di attack di security team call Safana chairman and police.

Bandits kill four in Wurma

Just before di attack for Baure village, another sey of bandits don already attack Wurma, kill 4 people including 2 women.

Wurma na village inside Kurfi Local Government Area, another area wey dey just 7 kilometers from Baure village where di bandits attack people and burn their shop and houses on Tuesday.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *