Popular crossdresser Idris Okuneye Olarenwaju AKA Bobrisky don comot for kirikiri prison after spending six months inside.
If you remember well, early this year them sentence Bobrisky to six months imprisonment on 12 April 2024 because him abuse Naira for party.
Bobrisky wey de call himself mummy of Lagos don dey prison since that April wey them arrest, but one video wey actress Eniola Ajao post for X, e show sey Bobrisky don comot for the prison wey them put am.
Eniola Ajao is trending because she was among the first people to welcome Idris 'Bobrisky' Okuneye back into the society this morning.
But it seems her social energy ran out by evening. Because she was conspicuously looking extremely out of place and totally lost at Bobrisky's… pic.twitter.com/X4qtgCJ7O7
— Trending Explained (@TrendingEx) August 5, 2024
Him come dey address him fans de talk sey “Him miss them wella and him no fit wait make e begin de give them wetin them miss.”
Following his release, fans of mummy of Lagos come de show excitement and the prepare towards him release party wey dey happen for Lagos.
Some of him friends come de use boat cruise to celebrate him release. And inside the boat cruise, Bobrisky come de advocate sey make people no abuse Naira again.