Popular crossdresser and social media influencer Idris Okuneye aka Bobrisky fit don land inside another wahala.
If you remember well, them bin sentence Bobrisky to six months jail term early this year for money laundering. After them release am for August, na so so wahala for left, right and center.
Now water don pass garri because him fit de face fresh criminal charges for some things wey him talk.
Claims Bobrisky made
As social media influencer wey him be, Bobrisky de do plenty shalaye and cho cho cho. Inside one of him talks him claim sey him no really go jail, sey him do him jail term for inside private apartment.
Him still stalk sey him bride some Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) officials make them drop di money laundering charges wey dey him head.
Backstory
Remember sey them bin sentence Bobrisky to 6 months jail sey him abuse naira since April, later on them come release am for August 5.
After him release, popular social critic Martin Otse aka VeryDarkMan or VDM come share one voice recording wey him talk sey na Bobrisky get di voice.
Inside di voice recording, Bobrisky claim sey him brine EFCC officials with #15 million make them for drop di money laundering charges for him head.
Him also talk sey him bribe prison officials make them for allow am make him serve him 6 months sentence for private apartment.
After VDM release di voice recording, minister of interior, Olubunmi Tunji-Ojo set up panel wey go investigate di matter. Di chairman for di panel na Permanent Secretary for di ministry, Magdalene Ajani, and na 30th September them set up di panel.
Report from the Panel
Inside their report, di panel talk sey no evidence to show sey Bobrisky no sleep for inside kirikiri for di 6 months. Sey wetin di crossdresser talk don tarnish di image of correctional service.
Them ask Department of State Service (DSS( make them investigate whether wetin Bobrisky talk na true if EFCC or correctional service collect bribe. Sey if them find out sey na true, make them charge am with corrupt practices.
And if n alie, make them sue Bobrisky for defamation as him don tarnish their image.