House of Reps dey consider one bill wey go establish Bola Tinubu University of Nigerian Languages, to promote di learning of Naija languages.
Dis move don cause mixed reactions among Nigerians, wit some dey vex, while odas dey see am as good tin.
A university for the husband.
A golden statue for the wife.Welcome to the kingdom of Nebuchadnezzar. Soon, Nigerians will be asked to worship them. pic.twitter.com/W3eZYUEZsb
— NEFERTITI (@firstladyship) October 12, 2024
The proposed focus of Bola Tinubu University
Di Bola Tinubu Federal University of Nigerian Languages go focus on teaching and promoting Naija languages, to preserve our cultural heritage.
Di bill, wey Deputy Speaker Benjamin Kalu and eight odas sponsor, don pass first reading for di green chamber.
Reps seek establishment of Bola Tinubu University to teach Nigerian languageshttps://t.co/VPw2JzFjfC
— Instablog9ja (@instablog9ja) October 12, 2024
How Nigerians reacted to the idea of Bola Tinubu University
Some Nigerians dey hail di idea, say na good tin, while odas dey query di priority, say the many challenges wey dey ground wey Nigerians don coin as T-Pain, suppose be government focus and not this.
Many Nigerians dey para sey government no dey serious at all, say them dey carry the country people dey play ontop the rising cost of fuel and food wey don impoverish the innocent citizens.
Some others dey make caricature of the idea to establish this university.
ADMISSION! ADMISSION!!
T-Pain University, Aba invites prospective candidates to apply for the following programs:
1. Electoral Electioneering
2. Maltachemical Engineering
3. Vote Buying Science
4. Narco Technology
5. Judisharing Law
6. Taxify AccountingAdd Yours 👇 pic.twitter.com/fmu8tLjzL1
— Ayemojubar (@ayemojubar) October 12, 2024
Bola Tinubu education agenda
President Bola Tinubu don show say im serious about education, recently im approve di establishment of seven new federal tertiary institutions.
Conclusion
Di proposed Bola Tinubu Federal University of Nigerian Languages don start national conversation about di importance of preserving Naija cultural heritage.
Wetin you think? Na good tin or bad tin?