Some memvers of di Nigerian Police Force on Sunday, January 12, 2025 catch one Oluwaimileyin Ajayi, one gospel artist and song writer for Orozo, a remote area in Abuja with him girlfriend head for nylon.
Timileyin wey them later discover sey na former gospel artist de carry bagco bag with plenty flies around di bags.
Members of di community come stop am,as him de look suspicious. During di stop and search, them see freshly cut head of girl for di bagco bag.
As fear catch them, di community members come call police officers hand over di matter to am.
Gospel Artist Kills Alleged Girlfriend In Orozo.
Some new update be sey, di lady, wey her identity still dey unknown no be di gospel singer girlfriend. Some don talk sey di lady no sabi di singer, na inside Keke them find her.
According to di rumors, Timileyin and one other of him cohort meet di victims for inside keke wey them board come drug di girl.
Inside di video wey de circulate for social media, some police officers carry Timileyin go him apartment for where him talk sey di remaining parts of her body dey.
As them reach there, them see sey him don cut her body into pieces package am inside three bagco bags wey them carry out inside di police van.
Lady killed in her apartment in Asaba
In other news, neighbors find di body of one lady simply identified as Lucy wey die for her apartment for Asaba, capital city of Delta State.
When her coworkers no see her for work for 3 days, them begin come ask about her from her neighbors. Di neighbors no sure for her whereabouts until them begin perceive strong odor from her room.
Di neighbors find some area boys to break di door only to see sey them rape her, kill her and steal her phones.
So far, no news about di people wey do am, but human rights activist, Harrison Gwamnishu don tell members of di public sey them go join head with police investigate di matter.