Gbege don burst for social media as tori about ending POS business restrictions for Nigeria spark plenty reaction.
Many Nigerians dey para say dem depend on PoS operators to withdraw money and pay bills, especially for areas wey bank and ATM no dey reach well.
I need the CBN to destroy this business of POS. Bring back ATMs, wtf.
— . (@FakhuusHashim) November 12, 2024
CBN and CAC leads charge for POS business restrictions in Nigeria
Na Central Bank of Nigeria (CBN) and Corporate Affairs Commission (CAC) dey push this restriction plan to regulate PoS matter and stop bad people from using it for crime.
CBN talk say the reason na to make PoS business legit, control fraud, and protect the economy, but many people no dey happy about am. Dem believe say e go spoil business for small PoS operators and make things hard for people wey dey use PoS daily.
Some fintech companies like Opay, Moniepoint, and PalmPay don beg government to balance the regulation well so e no go scatter wetin dem don build.
As Nigerians dey wait for final decision, the matter don open big talk on how to balance security and make financial service still reach everywhere.