200level OOU student Ayomide Adeleye kpai him ‘friend’ Christianah Idowu wey dey 300level for Federal University of Agriculture Abeokuta (FUNAAB) after him collect ransom of ₦350,000.
Linda Ikeji Blog (LIB) report sey, Christianah leave her house for Itaoluwo for Ikorodu in Lagos, de go University of Lagos where she de do her IT before them kidnap am for Ikorodu-Yaba road.
On August 19, her people declare her missing after the kidnappers use her WhatsApp message them to demand for ₦1,500,000.
JUST IN: 300 level Funaab student, Idowu Christianah has been allegedly murdered by her friend who kidnapped her after he initially demanded for N3M ransom from her family. pic.twitter.com/cgnmeiT7ci
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) September 4, 2024
The kidnappers later call her people around 8:30pm to demand for ₦1,500,000 as ransom before them go release am.
Her family try raise ₦350,000 go send am to one bet account wey the kidnappers give them.
Them come later transfer the money from the bet account to one Wema bank account. Na from the Wema bank transfer naim them come use trace the kidnapper.
As them dey investigate the matter, them come find out sey na one Ayomide Adeleye, for Olabisi Onabanjo University, Ogun State.
Based on some tweets wey him dey repost, X users de suspect sey him don already kpai many people like this years back.
Some people say him girlfriend been kpai like this for 2018. Later on for 2021 him sister sef follow kpai like this. Sey e be like na him do am, and na him steady way.
As them catch am, him confess to police and Christiannah parents sey him kpai Miss Idowu bury am for him room.The police don charge am to court.