After di Oblee season, a business owner and X user don de call out some IJGB wey defraud business owners for their Detty December.
According to di tori wey dey ground, di user with him handle, @bizzleisikoya report sey, him don receive many emails wey show sey di IJGB de initiate dispute, which done affect him business.
Meaning of Initiating Transaction Disputes
Usually when you make transfer into unfamiliar bank accounts, your bank go notify you dey you dey transact to unfamiliar account number.
You fit send the money, but since your bank don know sey na new account your send money to, them go give you di opportunity to fill out payment dispute wey go make freeze do money.
This means, di business owner no go receive di money on time, and if them no dey careful them fit no get di money at all.
Effects of Initiating Transaction Disputes on businesses
The main problem wey this dispute dey cause for business owners na to slow their cash flow. Once di money no dey flow back into di business, e de affect the operations and for small businesses, them fit crash.
According to wetin @bizzleosikoya write, him talk sey him don receive multiple disputes and e de affect him business cash flow.
“all of you UK, US and Canada people initiating dispute, is it really fair? If you don’t have money to spend for Detty December, don’t come, it’s not by force. My business has received 10 in the last one week. I can see your real names too, I just don’t want to embarrass anyone . But it’s really unfair. This last one is really paining me, $690 to # is a lot on my business “.