As Man United take win FA cup so, City fans still de try grab the kain juju wey United do for their team. If no be sey dem watch the match live, them for swear sey na soap Man United use.
As we don already know sey Man City no de take eye see cup and any cup wey dem see them go must to win am, na so this finals shock everybody, e come be like patient dog don finally chop fat bone.
As Man City take win Premier League champions four times straight, everybody bin de expect sey them go put am for united bodi woto woto. But e shock us!. Coming from 8th position on the Premier League table, United bin no get hope for next season. But as be like this, with their 2:1 win against City, them don get free pass for European football.
As e sweet Ten Hag for bodi, him come grant one small interview with BBC Sport, hear wetin him tell them:
“[My] compliments to the team. They played very good and to our identity.
“You have seen that when we have the players on board, how we can play to our philosophy.
“Some are not fit, expecially not match fit but I think the performance was very good.
“I tell you this all year. When the players are fit, we can play good football.
“You’ve seen a very good performance against the best team in the world, I think.”
Based on how bad the team perform this season, United coach, Erik Ten Hag don get last warning reach three times, with the promise to sack am if them lose this match. Some people wey for take over am be, Thomas Tuchel, Gareth Southgate, and Mourica Pochettino. But as e be like this, we no know whether them go give Ten Hag another last chance or, allow am make e rest small.