Many People Feared Dead in Abuja Building Collapse

FCT BC Many People Feared Dead in Abuja Building Collapse

Them don comot 7 deadi body for building collapse wey happen for Abuja on Sunday 27 October.

For Sunday morning, FCT Emergency Management Department talk sey them recover 7 dead iron scavengers (people wey de collect iron) for Sabon Lugbe one village inside Abuja.

As Reported by FCT Emergency Management Department 

Mr. Abdurahman Mohammed wey be di Director of di FCT Emergency Management Department talk sey more than 500 iron scavengers wey de collect iron enter inside one building wey them don demolish de find iron.

As them the pull di iron de drag am comot, di remaining part of di building fall on top of them.

Abuja building collapse

Di 7 people wey them recover dey among di people wey de drag do iron.

Mohammed Debunks Rumors

Mr. Mohammed talk sey rescue team don recover 7 deadi body and 2 others wey dey hospital for Federal Medical Center de receive treatment.

Him talk sey wetin some media don carry set na multi-storey building collapse and 40 people dey trapped no be true. Di building dey among other illegal uncompleted buildings wey FCT Department of Development Control de demolish.

Di iron scavengers enter inside after di Department don finish their work de find iron, na in di process naim di remaining part of di building collapse kill some of them.

Mr. Mohammed Expresses Disappointment

Mr. Mohammed talk sey him dey very disappointed with wetin di scavengers do because them don already see dey them demolish di building, them still enter inside de find iron.

Him continue to talk sey, wetin people talk sey na house wey human being dey live inside no be true, sey no human being dey live inside because na uncompleted building.

Even as di accident take happen some eye witnesses don talk sey other iron scavengers still de enter other demolished buildings make them find iron.

 

 

Emmanuella Koughna

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *