Amebo na Nigerian slang for person wey like cho cho cho. As in, person wey like to carry talk and breaking news all the time.
Whether e consign them or not, them go must talk wetin nobody send them.
Every family get one amebo wey de carry everybody matter for head. Na Dem de jam people heads well well because their mouth no fit stay one place.
If them ever call you amebo, e mean sey your mouth de run like tap and e no get control.
I never see anybody wey like Amebo pass this Onyeka, see as she dey turn neck left and right during the entire fight 😭😭pic.twitter.com/BQqqz6Cx9e
— Oyindamola🙄 (@dammiedammie35) August 18, 2024
Difference between Amebo and Cho Cho Cho
Even as them the go hand in hand, them get their unique meanings. Amebo na person wey dey like talk well well.
But cho cho cho na the the new one wey dey trend now to describe plenty shalaye.
For social media them de talk sey “cho cho cho show workings”. E mean sey, if you de talk plenty make you show evidence.
These days na girls de like use cho cho cho to describe man wey dey use plenty talk toast them. Especially of the man no de give them rabas.
So if you de toast girl wey you never drop money, them go talk sey na cho cho cho, make you show workings.