If you de follow some news agency like Punch NG, you for don see dey see say dem dey use ICYMI.
And on different formal and informal settings, you fit don also see “FYI” and maybe you don de wonder wetin these two abbreviations mean.
Meaning of ICYMI
ICYMI na abbreviation wey stand for “In Case You Missed It” and Punch NG de use am well well to help people find other news wey them don publish already.
But no be only Punch NG de use am since na very popular acronym wey people de use to remind other people about some things wey sup before.
ICYMI—THE FULL TRUMP RALLY IN WILDWOOD, NJ… pic.twitter.com/Lj1Vn7VVCA
— Dan Scavino Jr.🇺🇸🦅 (@DanScavino) May 12, 2024
For the case of Punch NG, them the use the acronym show their viewers other related news wey fit give them OT about wetin sup before. And this ICYMI wan take dey similar in meaning with FYI.
Meaning of FYI
FYI stand for For Your Information. Na usually when person wan remind another person about something wey them don forget or, something wey them no know.
As ICYMI take dey popular for news agency side, na so FYI take dey popular for social media side. And na usually when two people de exchange gba gbos naim them like to use FYI.