Kolo na old Nigerian slang wey mean madness or crase.
Them dey talk sey everybody for Lagos don mad. In other words, all Lagosians don kolo finish.
But no be only Lagosians kolo now, na everybody wey dey Nigeria de kolo because of how things don hard.
Una go pack things for body like person wey dey kolo una go call am Alte 💀 pic.twitter.com/BsXjOgEpkM
— #EndBadGovernanceInNigeria (@franksdonald) April 3, 2024
Worse na people wey dey on colos, those once their own kolo don pass normal level.
Kolo also mean sey na ment. If you de kolo then you de ment. Ment na new way wey Gen Z de use talk sey person don mad or kolo.
For instance if you cap or shalaye for social media, them go ask you “ment or malaria”. Meaning, you don kolo abi na sick you de sick.