Who dey breathe na popular slogan for Nigeria wey don trend for social media for a long time now.
Who dey breathe mean who dey alive, or who dey active for that time being. But di slang get deeper meaning sha.
Who dey breathe na phrase wey show say di person gallant and dey confident. E just be like to talk say “I dey alive” or “I dey here”.
You fit use dis one when you achieve something or you win small challenge or wahala.
Who dey breathe??? https://t.co/GwGoNUd4cB pic.twitter.com/a0HV7dXvk5
— Tao Of Iperu💡🦅🖤🇳🇬 (@TaoFeek182) April 4, 2024
Who dey breathe fit apply for other situation like when you win fight or any competition.
Like for sports or argument, person fit use di phrase to yab opponent, suggest say dem no dey for di game again or dem don lose.