No wam na short for no wahala or no yawa as the case may be.
While no wahala and no yawa na millennials slangs wey still dey around,no wam na Gen Z version wey de talk the same thing with the two.
No wam mean sey, no worry about am. And even as e dey similar to no yawa and no wahala, e get e own cases where them de use am.
The fact wanni has backstabbed onyeka is paining me sha, but no wam. pic.twitter.com/3tPMmpWuPF
— Danny💕💕 (@daniellamadu) August 26, 2024
No wahala fit for situations wey de give assurance sey true true, problem no dey. Na the same thing with no yawa.
ALSO CHECK: The meaning of Aproko
But no wam, na like way wey de show regrets. Like sey na you do yourself. Like now like this, many people wey no mine the $dogs coin wey just launch go talk sey “no wam”, because na them decide no mine am so them miss out on money.