Meaning of Oblee in Nigeria

December Oblee

Oblee na another new Nigerian slang wey dey trend for Nigerian TikTok this December. Di slang come out for November and small small, more Nigerians don de use am for their content.

As usual when new slang comot, no be everybody dey sabi di meaning sharp. If you dey among people wey wan sabi di meaning of Oblee, na di right place for you be this. For inside this article we don explain di meaning of Oblee, how e take start and how you go use am.

Meaning Of Oblee

Oblee na slang for “soft life”. Life without Sapa wey dey very comfortable with enough enjoyment and no stress. Some people de use am to mean celebration as well.
Di pronunciation dey like “Ob-lay” or “Obu-ley”, depending on which one fit you pass.

Origin of the Nigerian slang Oblee

Na for inside one TikTok trend song naim di slang Oblee comot from. Di lyrics of di song na plenty Oblee Dem de talk inside. Na for inside this trend nai di slang take start.

Many Nigerian slangs na extracts of Nigerian songs, proverbs or just some random words for Nigerian native languages like “Otilor” wey comot from Yoruba language, “Ike gwuru” wey comot from Igbo language and more.

Sometime di slangs no de get deep meaning na just based on vibes. Na so this Oblee dey. Na just random word wey them take give meaning.

Synonyms of Oblee in Nigerian slang

Just like oyibo words wey get synonyms, Nigerian slangs sef get their own synonyms. These synonyms de get close meaning with di word.
For Oblee, di synonyms na:

  • Soft life
  • Jaiye
  • Detty December
  • Jolly Jolly

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *