Meaning of Osubirile and Batawa in Nigeria

Osubirile

Osubirile don de gain ground as another social media trend.

If you be di kind person wey dey follow gist well for blogs, you supposed don see di word Osubirile and Batawa in one of di three major social media platforms: Facebook, X and Instagram.

As usual, whenever new slangs comot, people de wan know their meanings and how to use them.

Na why we decide to explain wetin be di meaning of Osubirile and Batawa and how you go fit use am.

Meaning of Osubirile and Batawa

Osubirile na from Igbo language them borrow di word from. And in Igbo language, Osubirile means “e don dey happen “ or “ e don start”.

Batawa na also from Igbo language them borrow am and e mean sey, “be coming “ or “dey come”.

Di two words combined de mean, “come oo, e don dey happen “.

Origin and usage of Osubirile and Batawa

Osubirile and Batawa start to trend few weeks ago when Cubana Chief Priest and Burna Boy been de get serious beef. Di beef been dey so heated that even some family members join head.

Wetin start di beef no too clear but any time wey Cubana Chief Priest wan sub Burna Boy, him go use, Osubirile and Batawa. Meaning, e don dey happen make people come see.

Usage

Di perfect time to use Osubirile and Batawa na when gbas gbos de happen for social media.
Especially for people wey like amebo and breaking news, them fit use di slangs to indicate sey drama don de happen.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *