Meaning of Zukwanuike slang

Zukwanuike woman

By now even pipo wey no be Nigerians suppose don hear zukwanuike for conversation on social media.

Nigerian slangs na some of the things wey no de ever finish for Nigeria be that.

Fuel fit finish, food fit finish but Naija slangs na till thy kingdom come. And some of these slangs na from the native Nigerian languages naim them come out from.

For example, Ike Gwuru na slang wey originate from Igbo language. Sojinu na another slang wey originate from Yoruba language. Likewise, zukwanuike na Igbo language get am.

Other slangs like steeze, ment, brother Bernard and co, na pure English wey them
be.

Meaning of Zukwanuike

Zukwanuike for igbo mean sey “have a rest” or “relax”. And na so e mean for Nigerian slangs be that. But no be every situation them the use am.

Even as the meaning of zukwanike dey the same both for igbo and Nigerian slangs, their use no too dey the same.

If you use zukwanike for igbo, e mean sey you de politely tell person make them relax. But when them use zukwanike for you in an argument, them want make you keep quiet.

Na indirect way of shutting person up be that. Na why if you notice an usually during social media arguments or drags them de use zukwanuike for person.

 

Emmanuella Koughna

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *