Nigerian Medical Association (NMA) Disowns alleged Doctor who killed EFCC Officer

Nigerian Medical Association Logo Nigerian Medical Association (NMA) Disowns alleged Doctor who killed EFCC Officer

Di Nigerian Medical Association (NMA) Anambra branch don comot talk sey them no sabi di alleged medical doctor wey kill EFCC Officer for Anambra.

In one statement wey di State Secretary of NMA, Dr. Obiaeli Ifeanyi post for him X page, di NMA talk sey di suspect, Joshua Ikechukwu no be member of their organization and him no be licensed practitioner.

Reports of di incident talk sey, Ikechukwu kill one Aminu Salisu, one EFCC Officer on Friday, January 17, 2025 for Dr. J. O Ukwutinife Close, Ifite, Awka, Anambra State capital.

After di incident, di EFCC suggest sey Ikechukwu na staff for Nnamdi Azikiwe University Teaching Hospital and him been involved himself in “online medical supplies of doubtful legitimacy”.

Suspected killer of EFCC Officer not a Doctor: NMA

Addressing di allegations wey EFCC raise, di NMA talk sey, people don too misuse di title “medical doctor”.

Them go ahead to denounce di suspect in their statement wey talk sey, “ Di attention of di leadership of NMA Anambra State dey on news publication wey them talk sey, medical doctor shoot EFCC officer for Awka.

Inside one of di publication them talk sey di suspect de work with Nnamdi Azikiwe University Teaching Hospital (NAUTH). After our investigation, we wan clarify sey Joshua Chukwubueze Ikechukwu, no be staff member of NAUTH, as we don confirm with di management.

Him no be member of MMA Awka zone, he no even be medical or academic doctor, na only medical equipment him de sell.

Di NMA Anambra State want to notify di media and EFCC wey talk sey di suspect na medical doctor. We dey demand make them withdraw their defamatory claims immediately”.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *