Nigerian slangs don grow pass border now as them don words like add japa, eba, abi and 17 others to Oxford English Dictionary.
Dese slangs wey them add to Oxford Advanced Learner’s Dictionary na regular street language wey Nigerians de use express their every day experiences.
Dis development don show sey pidgin English no be local language again as e don first some people enter Yankee and even people wey no be Nigerians fit use am.
How 20 Nigerian slangs made it to Oxford Dictionary
Kingsley Ugwuanyi,one consultant wey de work with Oxford English Dictionary make this announcement on Tuesday for LinkedIn.
As di development de give am joy, him quickly update for him LinkedIn sey,
“I dey very happy to announce sey Oxford English Dictionary (OED), Oxford Languages OUP don finally publish new updates wey include some Nigerian words inside. This words de reflect Nigeria’s culture, creativity and unique ways wey Nigerians de take express themselves “.
Nigerian slangs and pronunciation added to Oxford English Dictionary
Ugwuanyi also talk sey him no only write di slangs wey them add to Oxford English Dictionary, him also record di pronunciation of di words. Anytime wey person use di online Oxford Dictionary, na him voice th go hear. This na to help people wey no be nigerians.akr then sabi how to take pronounce di words well.
20 Nigerian words added to Oxford English Dictionary
The Nigerian words wey them add na very common words wey Nigerians de use for their day to day activities and them include:
- Japa
- Agbero
- 419
- Abi
- Adire
- Area boy
- Cross-carpet
- Cross-carpeting
- Eba
- Edo
- Gele
- Jand
- Janded
- Kanuri
- Kobo
- Naija
- Suya
- Yahoo
- Yahoo boy
- Yarn Dust.
24 Nigerian Words in Oxford English Dictionary
De recent addition na follow up update for other 24 Nigerian words wey don already dey inside Oxford English Dictionary since January 202 wey them add them.
Some of di words na:
- Agric
- Barbing salon
- Buka
- Bukateria
- Chop
- Danfo
- Ember months
- Flag-off
- Gist
- Guber
- Kannywood
- K-leg
- Mama put
- Next tomorrow
- Non-indigene
- Okada
- To put to bed
- Qualitative
- Rub minds
- Sef
- Send-forth
- Severally
- Tokunbo
- Zoning.
Conclusion
Dis development don showcase di influence wey pidgin English get for di world. A total of 44 Nigerian English don enter Oxford English Dictionary and more fit enter as new slangs de comot every year.