In di early hours of Wednesday, Dec. 18, Osun State governor, Gov. Ademola Adeleke post one report wey him get about one case wey dey happen for him state.
Di report an about one young man wey court sentence to death by hanging.
Based on di details wey dey di report, Gov. Adeleke talk sey na because of fowl wey do young man tiff.
Ademola Adeleke reacts to man sentenced to death because of chicken
Following di report, Gov. Adeleke talk sey him don talk to Osun State commissioner for justice and di Attorney general sey make them investigate di matter well.
Di governor talk sey make the. Pardon di man because Osun State na lan of justice and equity.
Quoting wetin him write for him X page, him talk sey,
“ I don receive di report of a case of a young man wey them sentence to death by hanging in Osun State because him tiff fowl. I don direct di Attorney general and commissioner for justice in Osun State make them investigate di matter and make them start di process to grand di young man mercy”.
Gov. Adeleke pledges to protect Osun State indigenes
Him continue to remind Osun State indigenes sey “Osun State na land of justice and equity and we go make sure sey fairness dey and humans dey protected.
I de assure di public sey this matter don get my full attention and I go handle am sharp sharp “.