Police officer arrested for Naira abuse

Okoyas sons Police officer arrested for Naira abuse

Di Nigerian Police Force arrest one of their members for abusing Naira inside one trending video with Wahab and Raheem Okoya.

Public Relations Officer for di police force, Olumuyiwa Adejobi publish this news for him X handle today, Friday, January 10.

Police officer arrested for Naira abuse in Lagos

Based on wetin Adejobi talk, na because di officer abuse naira for inside di video naim make them arrest am.
Naira abuse na offense wey dey punishable by law and anyone wey dey guilty go receive di punishment wey them deserve.

“We don arrest di police officer wey appear for di video with di two sons of Lagos businessman, Chief Okoya.”

We no encourage wetin di officer do because e dey unethical. We go always try our best to uphold di sanctity, credibility and core values of di Police Force. Thanks” na so Adejobi talk.

Naira abuse by Okoya sons implicates Police officer

If you dey active for social media, you fit don see one video wey trend last week.
Inside di video, di two Okoya Sons, Wahab and Raheem wear white agbada de use bundles of ₦1000 notes to promote their song “Credit alert”.

Di video also capture one police officer wey him identity still dey unknown for di background holding di money as di Okoya Sons de dance.

After di video go viral, Nigerians come react to am de criticize di police sey as na rich man children, them no go arrest them.

If you remember, di Nigerian Police been arrest popular crossdresser and socialite, Bobrisky last year April for this same Naira abuse crime.

After di reaction from Nigerians, police don confirm sey them don find di officer for di video and him go face di law.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *