TikTok and Instagram don dey buzz with new trending word “Demure” – but una know wetin e mean?
Meaning of Demure
According to the dictionary, “Demure” mean to be quiet and calm, like person wey no dey talk too much or do too much drama. But for social media, di meaning don change small.
Jools LeBron (1.3M TikTok) is the viral creator of the “demure” trend
It popped off 1 week ago & now feels like it’s everywhere pic.twitter.com/dZHXOX6k8d
— Danielle Vermeer (@DLVermeer) August 14, 2024
How people use it
For TikTok and Instagram, “Demure” mean to be soft and gentle, like person wey dey take am easy and no dey stress about anything. Na like person wey dey live di “no-worries” life.
People dey use di word to describe demself or dem friends wey dey calm and gentle. For example, “My friend dey demure, she no dey stress about anything”.
Fake “Demure”
But some people dey use am to describe di opposite – person wey be fake and dey pretend to be calm but dey get plenty drama inside, like the slang werey dey disguise. For example, “He dey demure but I know say he get plenty yawa for mind”.
So, make una shine una eyes and know di difference. “Demure” na di new word wey dey trend, but una no go use am do fake life, abi? Just be una true self and let’s keep di vibe real!