The meaning of “Touch Grass”

A need to touch grass

“Touch grass” na popular Nigerian slang making waves especially in di gaming and online communities.

Touch grass mean say make person no dey too spend time online, make e try go outside go experience real life.

Na like when person dey tell you, “Comot for screen small, go outside,” which means you don dey too focus for online or digital things.

Plenty activities dey wey fit apply to the phrase “touch grass”. Whether na to comot go enjoy life for eatery or to go play physical game like tennis or football, as far as say the activity no be wetin you go dey do inside your phone or computer, you don go touch grass.

Dem dey usually talk am for joke or to yab person, but sometimes e fit serious, to advise person make e balance between online and offline life.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *