After di announcement of their divorce, music legend 2Face dey face tough time with many of him colleagues like Toke Makinwa and Mary Remmy-Njoku.
E no longer be news sey di two love birds 2Baba and Annie dey go through a lot for their marriage and from di series of posts and videos wey him make yesterday e be like na di final bus stop for them be this.
2face Idibia affirms divorce rumours
Shortly after him make one initial announcement sey him and him wife don separate and file for divorce, di African Queen crooner face serious criticism from both young and old, some wey support am, some wey dey against am.
In another deleted post, him talk sey, them hack him account but him de try regain am. Many Nigerians suspect sey this particular follow up post na damage control for di first post.
As many people still de try understand wetin de really sup with di Idibias, Di 49 year old music doctor release video wey accept with him full chest sey na him write di post.
Celebrities take sides with Annie Idibia amidst divorce rumors
From di look of things, 2face Idibia don buy market from not just regular Nigerians but from him colleagues hand. Many of di popular names don make am clear sey them stand with Annie for this saga wey de happen.
“Actress Annie Idibia is in a very bad state and allegedly currently in Rehab. Insiders reveal that it is very very bad and the two people allegedly currently taking care of her are Singer Tiwa Savage and Media Girl Toke Makinwa”
— Stella Dimoko Korkus pic.twitter.com/tKJ83fRMXl
— @𝗼𝗻𝗲𝗷𝗼𝗯𝗹𝗲𝘀𝘀𝗯𝗼𝘆 (@OneJoblessBoy) January 27, 2025
Some popular names wey don declare war against di Love is a crime singer na fashion icon and socialite Toke Makinwa. According to Toke Makinwa, she and many other online in-laws dey ready to fight for Annie in case anything happens.
“This is wrong on all levels. You suppose hide your face as you carry this matter come social media, but as you think sey she dey alone, bring it on because you go fight all of us”. Toke Makinwa warns.
Other popular faces na Mary Remmy-Njoku of ROK TV wey don talk sey, 2face get plenty sisters-in-law wey go fight am.
“Bro Annie get family o, your sisters-in-law dey plenty and we don stay quiet out of di respect wey we get for her tough choices. But since you don decide to humiliate am at her lowest, No wahala, na your choice. Just make sure sey she dey healthy and okay. Because when di time reach, we get many questions for you”. Mary Remmy-Njoku talk so.
Annie reportedly in Rehab
According to blogger @officialstelladimokokorkus, Annie Macaulay dey rehab right now after di rumors about her divorce from her long time lover 2face Idibia enter internet.
According to di blogger, some insiders reveal sey Annie dey in a very bad state right now and two people wey de take care of am na Tiwa Savage and Toke Makinwa.
As news about di divorce continue to make waves for Nigeria internet, many people de wish di two of them well as them try to navigate di next stage of their lives.