No be news sey Nigerians and powerbank dey like 5 and 6. Anywhere you see 10 Nigerians stand, you fit sight like 3 or 5 powerbanks for some of their hands.
You no even blame them because, the way Nepa de do like sey na them de share long life and prosperity, anybody go tire.
If you see light today, you fit no see light tomorrow. If you see light next tomorrow, you fit no see light next week, na so the matter bad reach.
Na why many people de find the top 10 best Powerbanks for Nigerian smartphones in 2024, make them sef use their phones with rest of mind.
just learnt about this beast of a powerbank by oraimo and now i need this in my life yesterday. pic.twitter.com/ikzvB5ZDpS
— safaricon hater #2 (@dexxe) August 23, 2024
Na why we de suggest these top 10 ogbonge powerbanks wey go serve well well for Nigerians:
Top 10 Powerbanks in Nigeria
1. Oraimo Traveler 16000 mAh 12W Powerbank: 16000mAh Capacity(59.2Wh), dual input micro USB (5V, 2A), type C and type A (5V, 2.1A Max). Price #15,500.
2. Oraimo Traveler 20000 mAh 12W: 20000 mAh capacity (74Wh), dual input micro USB (5V, 2A), type C and type A (5V, 2.1A Max). Price #18,000.
3. Digifon’s Gorilla 1 and 2 Power Banks: 22.5 W charging speed.
4. 20000 mAh Power Bank Star 200: 20000 mAh capacity.
5. Elec Power Banks: 20000mAh capacity, ultra slim, portable and fast charging speed.
6. New Age Y107 Pro max Power Bank
7. Oraimo 27000mAh Power Bank: Lithium battery, DC input (5V, 2A) DC output (5V, 2A). Price #23,000.
8. Oraimo 30000 mAh Power Bank: input (5V,3A). Price #26,500.
9. Oraimo Wireless Power Bank: 5000mAh (18.5Wh), input (5V,3A/ 9V, 2A), output (5V, 2.4A), wireless output (7.5W). Price #29, 100.
10. Romoss 20000 mAh QC type C Power Bank: 20000 mAh capacity.
Factors to consider before choosing a Powerbank type
E get some one or two things wey you go consider before choosing power bank for your smartphones. These factors na things wey if you ignore them, kasala fit burst later later, or you go just de carry your hand buy wahala:
Capacity: capacity na the power wey the power bank fit hold. Power Bank wey get big capacity na good one wey go last well well.
Charging speed: you go also consider the charging speed of the power bank. How fast and many hours e de take am to charge your phone.
Portability: because na backup power supply no mean sey you go de carry transformer de waka about. Portable power bank wey go fit inside your bag or pocket dey alright.
Compatibility: no be every power bank go work with your phone. If you de use ogbonge phones, you suppose buy ogbonge power bank wey go serve am well. Some power banks de charge very slow, those kind ones fit spoil your phone battery.
Durability: things don too cost, na why you gats shine your eyes well make you buy power bank wey go last for your hand.
Conclusion
Nowadays power bank be like necessity for every Nigerian wey dey use smartphone, because of how many people de use their phones do business, e no go good make their phones de go off anytime.
Na why more and more companies don de manufacture power banks be that. But as them take boku, na so yeye yeye ones sef dey. If you no take time, you fit go buy wetin go come increase your wahala.
Na why e good to first check the top 10 best Power banks for Nigerians in 2024, make you know wetin you de use your money buy.