Trump’s crackdown: 3,690 Nigerians to be deported from the U. S

Nigerians face deportation from the US

About 3,690 Nigerians dey among di list of people wey new American president, Donald Trump go deport from di United States of America.

For inside di circular wey di U. S Immigration and Customs Enforcement, ICE, release, a list of some illegal immigrants alongside their and nationalities been dey.

Di circular also reveal sey as at November 24, 2024, 1,445,549 illegal immigrants go likely face deportation.

Inside di same document wey them title,“Noncitizens on the ICE Non Detained Docket with Final Orders of Removal by country of citizenship “, show sey Mexico with 252,044 and El Salvador with 203, 822 na them de top di list of di nations with di highest number of people wey them go deport.

What to know about the ICE

Immigration and Customs Enforcement, ICE, na agency wey dey in charge of protecting America from illegal immigration and other crimes wey de threaten their national security.

Before them officially release di list of people wey them go deport, them been arrest hundreds of immigrants while others run comot through military aircrafts as president Trump been don already promise mass deportation during him inaugural speech.

Trump talk sey him go fight illegal immigration and him go make immigration policies more hard for people wey wan enter America.

Him also talk sey him go cancel citizenship by birth for children of illegal immigrants. This promises been put fear for many people body including some Nigerians wey dey love there illegally.

Unfortunately for them, 3690 Nigerians dey among di list of 1.4 million people wey dey face deportation for America.

Trump declares national emergency at Mexico-US border

True to his words, Donald Trump de fulfill all di promises wey him give about illegal immigration with his focus majorly on Mexico.

No be only sey them dey among di countries with di highest number of deportees, but Trump don sign order sey make them declare national emergency for di Mexican-US border.

Presidency ready to welcome 3,690 deported Nigerians from the US

After them publish di list of de deported illegal immigrants, di Nigerians in Diaspora Commission talk sey di Federal Government dey ready to welcome deported Nigerians from di United States of America.

Director of Media and Corporate Affairs of di commission, Abdur-Rahman Balugun tell Vanguard on Tuesday sey di Ministry of Foreign Affairs dey in charge of di matter.

Balogun talk sey, FG don already set up committee wey go handle di case.

“Di Federal Government of Nigeria don set up inter-agency committee wey include Ministry of Foreign Affairs and NiDCOM, Ministry of Humanitarian Affairs and office of di National Security Adviser NSA, in case of mass deportation wey go affect some Nigerians in the U.S “.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *