Anoda slang wey dey ground na “Aza” and “Azaman”, and e dey very popular across social media space.
Dis two Nigerian slangs wey dey in great usage get close meaning, but wat does it really mean?
Meaning of Aza
Well, without much issues, Aza means bank account! Dat’s right, when somebody ask you “How much you get for your Aza?”, dem no dey ask you about your health or well-being, dem dey ask you about how much money you get for your bank account!
Drop your AZA asap if you're following
I’m sharing 1m Naira for the first 1000 Likes, RT & FOLLOW ❤️ pic.twitter.com/OC0x0g6FsP
— Sirbalow (@_sirbalow) July 30, 2024
According to sources, di slang “Aza” start from di streets of Lagos, where people dey use am to refer to their bank accounts. Now, e don spread to di whole country, and everybody dey use am, just like “Cut soap for me“.
People dey use “Aza” for different tings, like when dem want to ask you about your financial status, or when dem want to send you money. For example, dem fit say “Make I send you money for your Aza” meaning “Let me send you money to your bank account”.
Even celebrities dey use di slang, like Wizkid and Davido. Dem dey use am for their social media posts, and dem dey even mention am for their songs.
So, if somebody ask you about your “Aza”, no be confuse. Dem just dey ask you about your bank account, and how much money you get for there. Make una no forget say “Aza” dey here to stay!
Meaning of Azaman
We been don yarn say Aza and Azaman get close meaning abi? Yes, as e be so, Aza mean bank account while Azaman mean person wey get account wey dey receive funds wey for hard currency.
Azaman also mean person wey dey serve as middleman for transaction. But while Aza no dey too raise people curiosity, anybody wey dem dey call Azaman dey get tag as Yahoo Boy.
Azaman come also be song title from Nigerian music sensation wey them dey call Remo.
.@heisrema’s “AZAMAN” (Official Music Video) has surpassed 1 Million Views on YouTube. #HEIS pic.twitter.com/c2FFbo5f1a
— REMA STATS (@RemaStats) July 30, 2024
Di music star dropped the song video late July for 2024.
As our society no support online fraud, if you be Azaman, we dey urge you make you stop to dey use your account for bad purposes make law enforcement no knock you down one day.
In all, make we dey make money in a good way so that God go bless our hustle and bad money no go enter our Aza.