Them sey wahala be like bicycle. Inside one trending gist for X, one man don lose him new pikin sake of sey him insist sey him wife must born like Hebrew woman.
According to the gist wey originate from Facebook, one woman narrate how she go donate blood for woman wey her husband refuse to sign consent form for Checking or CS for him pregnant wife.
C-section or CS na procedure wey doctors dey do for pregnant women belle when e dey hard them to born.
This procedure require sey them go open them woman belle commot the pikin come stich am back.
Before them carry out the procedure, adult must sign. That adult go either be the woman if she still dey conscious or, any of her relative wey dey close.
Woman reportedly loses baby after her husband refused to sign the consent form for a C-section. pic.twitter.com/9TT7Ff4JKG
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) September 25, 2024
The reason why Husband refused to sign C-Section Consent Form
According to the story, the man talk sey him no believe in C-section, sey as a real woman, him wife must born the “natural way” (through her private part) or she no be true African mother.
People wey follow dey the hospital like the woman mama, the nurses and doctors try beg them man sey the condition dey critical and na CS go help them.
But the man refused, sey even the cost of doing CS no be beans, make them wife push.
The wife push sotey them pikin kpai because of stress and the woman dey in critical condition wey require blood.
Na this narration spark many opinions for X, many people de vex anyhow sey the man na wicked man.
Other women de blame the wife sey na her life she de use play ludo. Sey she suppose sign the form herself.