One X user with the handle @raffayalvl go him X page go de praise one honest Nigerian Man wey refund am for crypto giveaway.
For the post wey di man make, him talk say during the giveaway wey the Nigerian man with the username @muchino67 win, him do mistake send am 100 SOL instead of $100.
And the value of the SOL na $14,000 which if you convert am based on our current exchange rate, e fit reach ₦20 million
Out of fear, @raffayalvl come message @muchino67 say him do mistake and if him go fit send am even if na $SOL90 so that him go keep the remaining $SOL10.
I ACCIDENTALLY SENT SOMEONE 100 $SOL INSTEAD OF $100
THIS IS WHAT HAPPENED… 👇🏽
GOD BLESS YOU @muchino67 pic.twitter.com/ps4O00YAtu
— The Crypto Network (@raffayalvi) July 2, 2024
E shock am say the Nigerian man send the complete $SOL90 as him ask. As happiness wan choke am, him make live video with @muchino dey thank am.
Raffayalvl still later post for him Twitter page say hope still dey, with Nigerian flag for the tweet.
Because of how honest @muchino67 dey, people come donate up to $5,000 for am to appreciate am, and many other top crypto traders come recognise am tell am say dem go help am anytime wey him need anything.