As them the dig deep into one accident wey happen for Ibadan, e show sey, at least 25 people don die for the accident today Tuesday, August 13, 2024.
This accident happen along Ojoo-Iwo road near Agbowo/Ajoa for Ibadan, the capital city of Oyo state.
Based on some update wey dey ground, one trailer wey carry roofing sheets jam one 18 seater Hummer bus, one taxi and one Honda CR-V car.
The accident no be small one, and e kpai some people wey dey inside the vehicles and some na injury them get.
The time wey them report the accident, some people wey been dey near the place try rescue some of the accident victims carry them go hospital.
A tragic accident occurred on Agbowo Express in Ibadan, involving several vehicles. Sadly, many lives were lost.
May God bring comfort to the families of those who have passed away. pic.twitter.com/1GVSCrYP7c
— Hon. Jesugbemi (@Jesugbemi4) August 13, 2024
Because of the accident, people begin to gather for the place and e cause small hold up wey Federal Road Safety Corps de try to control.