Idris Okuneye also known as Bobrisky don land for EFCC hand once again.
The popular crossdresser been de try comot for Naija when immigration officers catch am for one flight wey do go Amsterdam for Murtala Mohammed International airport Lagos.
This event happen on Thursday, October 31. Confirming the incident, Bobrisky post for him Instagram story sey make Nigerians help am, EFCC don arrest am and him dey badly injured.
Bobrisky Intercepted at Sème Border
Before this arrest, immigration officers been catch Bobrisky for Sème border when him de try run from Naija through Benin Republic.
This rearrest de come after EFCC confirm sey, Bobrisky fit face fresh criminal charges for the controversy wey the surround him first arrest in April.
After them release am, him make plenty claims sey him bribe some EFCC and prison officials make them allow am do him jail term for private apartment.
This talk come bring up fresh charges for him head, and since then, na the second time wey them the arrest am be this.
Bobrisky Calls for Help
On the early hours of 1st Nov. Bobrisky post for him Instagram de cry out for help. Him post sey “Nigerians help me, EFCC just arrest me. I dey badly injured”.
To backup him claim, him post some graphic pictures of him injured hand for the status.