Di National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC, don warn Nigerians against the use of Nivea Black and White Invisible Roll-ons.
Inside one circular wey NAFDAC release, them don flag one product with batch number 93529610 and barcode number 42299882 wey them produce for Germany.
This product contain 50ml Nivea Black and White Invisible Roll-ons wey them talk sey e de provide 48-hour protection for Africans.
This statement from NAFDAC comot after European Union Rapid Alert System for Dangerous non-food products in Brussels warn against the products.
NAFDAC Warns Against Harmful Chemicals in Nivea Roll-ons
Public Alert No. 041/2024.
Alert on the recall of Nivea Roll-on deodorant due to safety concerns by European Union Rapid Alert System for Dangerous Non-Food Products (Rapex) Authorities.#NafdacALERTSRead more >> https://t.co/8AcxKSNS4M pic.twitter.com/dKEYty6YG6
— NAFDAC NIGERIA (@NafdacAgency) October 31, 2024
Inside the notice wey NAFDAC release on Thursday, October 31, NAFDAC talk sey
“Them report sey the recalled Nivea product contain 2-(4-tert-Butylbenzyl) propionaldehyde wey be harmful chemicals wey no suppose dey inside cosmetics.
This chemical de cause issues to reproductive system, and e de affect unborn babies for belle. E also de cause skin irritation and burns.”
This na wetin NAFDAC talk. Them go ahead to talk sey this product na for Germany them manufacture am, and the barcode number na 42299882.
NAFDAC Warns Against Fake Condoms
In the same spirit of warning Nigerians against fake products, NAFDAC de alert Nigerians about fake condoms wey dey market.
On Thursday NAFDAC call Nigerians make them dey aware of unregistered condoms like fuola condoms.
Fuola condoms na new condoms wey NAFDAC officials from Post-marketing Surveillance Directorate discover .
For now, the Fuola condoms na for Abakiliki, Ebonyi State and Zango for Katsina State them the sell am. Them de package three for one pack.
Na during one of their Risk Based Post-marketing Surveillance study on registered condoms in Nigeria naim them discover the condom.
NAFDAC talk sey them no register di condom for Nigeria and the language wey dey di label no be English language.
” Using condoms na effective ways to prevent both pregnancy and HIV and other sexually transmitted infections. To get good results, any prevention method wey you wan use you have to do am well.
To de sell and use poor quality condoms go affect the promotion and use of condoms to prevent and infection. If di condoms break, them no fit offer the protection wey them suppose give”. Na wetin NAFDAC talk.