Army chief Lagbaja dies at 56

Army chief Lagbaja

Tragedy hit Nigerian military as di Army Chief of Staff (COAS) Maj. General Taoreed Abiodun Lagbaja die for Lagos on Tuesday.

Na di special adviser to di president on Information and Strategy Bayo Onanuga naim make di announcement on behalf of president Tinubu.

Di president talk sey, Lagbaja been die on Tuesday night for Lagos after one brief sickness.

Di COAS Lagbaja been dey 56 years when him die, and him don serve in di Army for long now.

Brief history of COAS Lagbaja

Na on 28th February 1968 them born COAS Lagbaja. Him begin him military journey for 1987 come finish am for 1992 and since that time, him don serve di country in different capacities.

After him graduation, them commission am as second lieutenant for Nigerian Army Infantry Corps wey be part of di 39th regular course him take.

Him serve as di platoon commander for 93 battalion and 72 Special Forces battalion.

During di time wey him serve, him participate for many operations like Operation ZAKI for Benue State, operation Lafiya Dole for Borno State, Udoka for Southeast Nigeria, and Operation Forest Sanitary for Kaduna and Nigeria States.

COAS Lagbaja been graduate for US War College where him get him Master’s in Strategic Studies before him appointment.

COAS Lagbaja appointment

After all him achievement and service to di nation, president Ahmed Tinubu appoint Lagbaja as di CHief of Army Staff (COAS) for June 19 2023 where him serve till him die at di age of 56.

Him leave behind him wife Mariya Lagbaja and two children.

President Tinubu send him condolences to di family of di late army chief as him also praise am for all di hard work wey him don do for him office as COAS.

“President Tinubu de send him heartfelt condolences to di family and di entire Nigerian Armed Forces during this diffult time. Him de wish Lt. General Lagbaja eternal peace”.

 

 

Emmanuella Koughna

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *