Rivers State Government don confirm sey nine people die from wetin them de suspect to be cholera outbreak for two Local Government Areas in di State.
Di States commissioner for health, Dr. Adaeze Oreh, give this update on Thursday, Jan. 16, 2025, during one press briefing for Port Harcourt, di State capital.
Dr. Oreh reveal sey di two communities affected an Andoni where three people die and, Akuku-Toru where six people die.
She talk sey them don record 41 suspected cases of cholera and di state government don de make moves to fix di issue.
Rivers State Government has confirmed the deaths of 9 persons following a suspected cholera outbreak in two local government pic.twitter.com/3NjSLBWBxr
— Naija (@Naija_PR) January 16, 2025
Rivers State Government Warns Against Cholera Outbreak
Di health commissioner talk sey even though them never too sure sey na cholera kii di people, di symptoms resemble.
“With di deepest sympathy to di victims, we de investigate di suspected outbreak for Isiodun community for Andoni LGA and di symptoms resemble cholera”. Na so she talk.
Cholera na disease wey come from Vibrio cholerae, one bacteria wey de grow for dirty water and environment.
This disease fit enter your body if you drink dirty water or food wey dey contaminated with di bacteria.
Di commissioner still talk sey Rivers State get high chances of di outbreak during dry season.
Oreh tell di residents of di communities sey as them de try to investigate di matter, make them follow try to prevent di spread.