Di Organisation of Petroleum Exporting Countries, OPEC, don talk sey Dangote refinery dey affect European markets because important of petroleum products don reduce for Nigeria.
According to report wey OPEC drop on Wednesday, Jan. 15, 2025, importation drop during di last quarter of 2024.
“Di imports don reduce especially oil products”. OPEC
Dangote refinery start to produce petrol in September 2024 to mark progress in di Nigerian energy sector.
Since then, di production don reduce de level wey Nigerians de import petrol and its products from foreign countries.
Petrol Production At Dangote Refinery Is Affecting The European Market — OPEC pic.twitter.com/ApmTwPWsYg
— Instablog9ja (@instablog9ja) January 16, 2025
OPEC records increase in production
According to wetin OPEC talk, in December 2024, di average daily crude production reach 1,509 million barrels.
OPEC talk sey Dangote refinery wey de produce 650,000 barrels per day (BPD) dey 24600 BPD more than wetin Shell Persins refinery for Netherlands de produce.
Di refinery still pass di BP Rotterdam refinery in Netherlands by 380,000 BPD.
OPEC predict sey based on di operation wey de happen for di refinery, e go still go higher in di gasoline market.