At least fifteen people don die from road accident wey involve trailer and another vehicle for Oko Olowo area of Ilorin-Jebba expressway for Kwara State.
Reports talk sey apart from di fifteen people, other people follow get different levels of injuries for di accident.
Eyewitnesses don narrate their side of story sey di accident involve one trailer with vehicle number AYE 218 XC and another vehicle with registration number TTN 556 XA.
18 killed as trailer conveying cows, mini truck collide in Kwara | TheCable https://t.co/PxEWHNI3Dt pic.twitter.com/jOeJuT261m
— TheCable (@thecableng) January 23, 2025
This accident happen on Wednesday, January 22, around 6:00 Pm when di two vehicles de travel different directions before them jam.
According to di update, one of di vehicles carry cows and some humans from Ilorin de go Ogbomosho in Oyo State, while di trailer de move from Lagos to Kano.
Some emergency response team and some police officers from G division command Oloje been arrive di scene on time to carry di injured victims go hospital, while them try to move di dead bodies wey scatter everywhere for road.
So far, di cause of di accident still dey unknown as di police still de try investigate di matter properly.
FRSC Commander confirms death of 15 passengers
Di Federal Road Safety Corps sector commander of di FRSC Kwara command, Muftau Irekeola on Thursday, January 23, confirm di incident sey 15 people don die but him still de wait for more details as him men dey investigate di matter.
“E no dey far from di truth sey we get 15 casualties, but I still de wait for more details from my boys. Na multiple accident wey involve one trailer and one Canter truck”.