Four soldiers of di Nigerian Army wey them attach to di Myoung Barracks for Morocco in Shomolu area of Lagos don lose their lives after one drunk driver jam them.
According to PUNCHNG di drunk driver jam di soldiers as them comot for their monthly road jogging outside di barracks early in di morning on Friday, January 31st, 2025.
One eyewitness, Priscilla, narrate sey di Toyota wey jam di soldiers been carry three young men inside and dey move at very high speed before jamming di soldiers.
BREAKING: Scores Killed As ‘Drunken Driver’ Rams Car Into Soldiers In Lagos
According to reports, four soldiers attached to the Myoung Barracks in the Morocco area of Shomolu, Lagos, have been feared dead, and others were injured after a suspected drunk driver rammed into them.… pic.twitter.com/8iTVGLm3Wi
— The News Chronicle (@TheNewsC) January 31, 2025
After them hit di soldier, di men try to tuama before people catch them come vandalize their motor. In di process, them stab one of di young men.
“Di incident happen for early hours of this morning when di soldiers comot for their monthly morning road walk when di young men jam them for front of barracks.
Four of di soldiers die instantly while others get injury. After di incident, di boys attempt to run away but then catch then beat them to stupor while them vandalize their car.
Also some soldiers stab one of di young men. Di incident don cause panic for people wey dey stay for di area”.
So far, since them report di incident to Deputy Director of Army Public Relations, 81 Division, Olabisi Ayeni and di spokesperson of di Lagos State Police Command, Benjamin Hundeyin, them never respond to di reports.
Sixty seven dead in US plane crash
In other news, 67 passengers don lose their lives for plane crash wey happen near Ronald Reagan National Airport for US.
Di news wey Al Jazeera cover show sey di incident happen at 9:00 pm on Wednesday as reported by di Federal Aviation Administration.
Two aircrafts wey dey involved in di accident na PSA Airlines Bombardier CRJ700 and US Army Sikorsky UH-60 Black Hawk helicopter.
According to di US Federal Aviso Administration, di plane been carry sixty passengers and four crew members while di helicopter been carry three personnel.
Upon hearing di sad news, president of di federal republic of Nigeria, Bola Ahmed Tinubu sympathize with di US government and di entire people of America.