Innocent Idibia alias 2face don reveal di face of him new babe, weeks after rumor of divorce from him, Annie Idibia.
Despite all di trolling and threats wey di legend receive from Nigerian online in-laws and him industry colleagues, 2face don find love with Hon. Natasha Osawaru of Edo State.
In one post wey him make for him Instagram page , 2baba de ask Nigerians make them help am beg Natasha to marry am.
Wetin 2face dey do?😭😭 pic.twitter.com/2LUomYXfuX
— Oyindamola🙄 (@dammiedammie35) February 12, 2025
Nigerians react to 2face’s new love interest
As usual, di post spark different reactions and opinions from Nigerian social media as them struggle to make peace with di situation.
Former BBN season six housemate, Vee Iye don use meme remind Nigerians of her earlier comment wey she hint sey, even with di drama wey happen between di Idibia’s, another woman dey wait in line.
While some dey call am out for irresponsibility, others de encourage am sey as long as e go make am happy make e do am.
Entrepreneur, Isaac Fayose don declare im support for 2face for him new video. Him talk sey as long as 2face dey happy, make him no send anybody.
“Mr. 2face if your spirit de tell you sey make you marry another wife, make yourself happy “. Fayose talk.