EFCC charge suspected Scammer for Lagos High Court

EFCC prosecute Internet fraudster

EFCC Don Carry Suspected Internet Scammer Go Court for Impersonation for Lagos

On Monday, June 10, 2024, Lagos Zonal Command of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, carry suspected internet fraudster, Victor Fasuba, go court for one-count charge wey concern scam impersonation for Justice Kehinde Ogundare hand for Federal High Court wey dey for Ikoyi, Lagos.

Di one-count charge talk say: “You, FASUBA VICTOR OLUWATOSIN, sometime for November 2023, for Lagos, inside di jurisdiction of this Honorable Court, pretend say you be one ‘Arrow Grant’ as you use him identity for Facebook page, with plan to benefit yourself and thereby commit offence wey dey contrary to and punishable under Section 22(2)(b) of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention etc) Act, 2015.”

E gree say e commit di offence when dem read am to am. As e plead guilty, prosecution counsel, Z.B. Atiku, come wan review di facts before di court. But Justice Ogundare, adjourn di matter go June 25, 2024, to review di facts.

Di defendant go continue for di administrative bail wey EFCC don give am before.

Strength James

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *