Nigerians don call out EFCC ask Dem why di former Kogi Governor still dey waka free concerning Yahaya Bello case.
Remember say for April EFCC been bounce enter Bello house for Abuja to arrest am for alleged N84bn, $720k state fraud. Kogi IGP send officers to fight dem (EFCC) off.
Later, Kogi present Governor, Usman Ododo, go find way comot Bello.
EFCC come declare am wanted, wey come make di APC man become fugitive automatically.
This thing pain EFCC chairman Ola Olukoyede, till e swear say if e no arrest Yahaya Bello, e go resign.
E don reach two months since di swearing and since dem declare am wanted by EFCC. And never talk anything about di case. But EFCC brutalize people for one night club for Akure on Friday night.
So, Nigerians dey now ask EFCC for update. Because e come be like say di commission dey target only di youths.
But many believe say di case don end, ‘as usual’.