Nollywood actress Chika Ike today share pictures of her new born baby girl.
In one new Instagram post, she caption di pictures, “My baby is here. Welcome to the world my sunshine”.
"My baby is here" – Actress Chika Ike welcomes her new born baby girl pic.twitter.com/Vr6OSIgYCy
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) March 6, 2025
If you remember clearly some days ago some rumors been comot about di actress and Delta state politician, Prince Munir Ned Nwoko. According to di rumors, some people been allege sey Ned Nwoko been de plan marry di actress as him seventh wife.
This rumor been resurrect old stories of di actress been involved with di senator some years ago even before him marry actress Regina Daniels.
Ned Nwoko debunks rumors of marrying Chika Ike
Senator Ned Nwoko been debunk di rumors because “na just baseless and product of malicious speculation “, as him term am.
In one statement wey di senator publish for him Instagram page, him talk sey,
“ Them don call our attention for some recent rumors wey de talk sey Senator de plan to marry Nollywood actress, Chika Ike as him seventh wife and she dey pregnant for am. We want to clear di air sey di claims dey baseless and na product of malicious speculation “.