Victor Osimhen vex for Coach Finidi

Victor Osimhen don vex for Coach Finidi George

Pidgin News dey report say Super Eagles striker Victor Osimhen decide go live for Instagram begin para give him coach.

Wetin cause this drama be sey, super Eagles head Coach Finidi George de complain about di behaviours of some Super Eagles players. Sey them no de cooperate with am.

Fimdi come use Osimhen as scapegoat, sey e be like the Napoli striker dey choose the matches wey him de play for National team. And him coach no fit beg Victor make him play for him own country.

According to gist wey don already dey ground, Osimhen bin tell Coach Finidi say him get injury for him ankle and him no fit play. But Finidi talk say, Osimhen for manage play for him team.

All this talk come after the Super Eagles play four matches against Lesotho, Liberia, South Africa and Benin Republic, and dem no win anyone. If dem no draw do match, like dem do am with South Africa, dem go lose.

The coach come de complain sey the players no get discipline and based on the kind connection wey dey the team, him no fit sanction them the way him want. Because dem go tell am say na one big man get so so and so player.

Coach Finidi come dey blame Nigeria Football Federation (NFF) say, as dem employ am, dem no de support am at all, say the players just dey do as dem like and him no fit do anything because him no get backing with NFF.

Finidi don resign from Super Eagles

After Coach Finidi talk him mind, him come resign because of the plenty talk wey comot for Nigerians side. Some people dey blame am say, him no fit manage people, others de talk say, shey Osimhen don tell am say him get injury, why him no put other players like Boniface?.

Others dey call Finidi jealousy coach, say him don dey drag jersey with player. Say e no go shock anybody to discover say him dey jealous of him players.

Osimhen Para For IG

As the talk pain Osimhen reach him bone, him come go live talk say him been tell the coach say him get injury but him go dey camp with the other players, but the coach refuse.

Osimhen talk say, him no too send anybody papa, and anybody fit believe wetin them wan believe, e no concern am. But him no fit sidon make person dey spoil him name, dey disrespect am.

Him para well well for di video come add say, whether him dey choose the matches wey him dey play or not, people sef know say, if him dey play, him de put all in mind dey play well.

Say if dem like sef, him go post the videos wey him bin dey talk with the coach after him visit doctor. Say him gats do MRI after the injury wey show say true true, him leg no dey alright.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *