Dem recently hold di Ojude Oba Festival wey de happen every year for Ogun State. For inside di festival, you go see people wey dey different age go wear very colourful aso oke come gaj up for di event.
This event de happen on di third day of Eid and this year, na June 18 e happen for di Awujale’s Pavillion.
For di event different things de happen like fashion parade, where both old and young people de show their talents, cultural dance and horse riding.
Every year when this event happen, e de loud for social media based on how colourful and attractive e dey. And this year sef no difference because di colours choke!
What Is Ojude Oba?
Ojude Oba (the king’s forecourt) na festival wey Yoruba people of Ijebu land for Ogun state Southern Nigeria de celebrate.
Usually when them de celebrate di festival, you so see different bright colours of aso oke wey de “regberegbes” (different age groups) de wear.
The main purpose for di event na to pay respect to di Awujale of Ijebu land, Oba Sikiru Adetona.
The Ojude Oba Festival first start to enter social media people eye from last year when pictures for di event trend, this year own come double, the steeze come increase pass wetin happen for last year.
FG Seeks UNESCO recognition For Ojude Oba
Minister of Culture, Art and Creative Economy Hannatu Musa-Musawa tok on Tuesday sey FG de plan to list Ojude Oba as one festival wey United Nations Educational, Scientific and Cultural Organisation (UNESCO) approve and support.
Di person wey represent am na Dr.Ben Anama, him tok sey di festival dey in tune with president Bola Ahmed Tinubu‘s mandate wey plan to generate revenue from tourism and raise am to over $100bn by 2030.