Senate President Akpabio apologizes to Natasha Akpoti

Senate President Godswill Akpabio

After Gistlover drag am like small Tiger Gen for Instagram, Senate president Godswill Akpabio don apologize give Natasha Akpoti Uduaghan for the thing wey him talk.

Wetin happen be sey, on Thursday, 18 July 2024, inside one meeting wey been happen for lower chamber, Mrs. Akpoti follow Akpabio talk. And based on sey him no ask am anything, Akpabio come tell Natasha sey make she no de do cho cho cho de chook mouth for matter wey them no ask am, sey where she dey na senate and not a nightclub.

IMG 20240724 WA0003 Senate President Akpabio apologizes to Natasha Akpoti
Senate President Godswill Akpabio & Natasha Akpoti

This talk wey him talk come provoke Nigerians and many of them come de tell the Senate president sey him no supposed de talk to him colleagues like sey them be small pikin.

Where di matter come tie wrapper na when Gistlover wey be blogger wey nobody sabi who get am, come de pressure Akpabio sey him must to apologize give Akpoti.

Gistlover come give Senate president few hours sey if him no apologize, him go cast all him matters. Like joke like play, Gistlover begin drop list of girls wey them think sey na Akpabio side chick.

IMG 20240724 WA0002 Senate President Akpabio apologizes to Natasha Akpoti
Senator Natasha Akpoti

Gistlover come drop Akpabio number with him wife and side chicks number. Na so Nigerians follow torment them with calls and messages.

As things dey go, Akpabio come apologize talk sey no be sey him de look down on women o and him dey sorry for the nightclub comment. Sey him wife wey him respect come tell am sey them wan finish her batteries with calls sey him no know sey him de trend for social media.

Him follow talk  sey him no get any girlfriend, sey na only one wife him marry and e don do am. Nigerians come dey happy as him apologize sey even if the side chicks list no true, at least him listen and him take action.

Emmanuella Koughna

Emmanuella Nguavese Koughna sees writing beyond a means of survival, to her, the ability to weave words into scenery and tell stories of herself and others is indeed a gratifying one. To her, writing is a privilege that she considers, greatly underappreciated, because it is beyond words: writing is taking a walk through an author's mind, seeing the world through multiple lenses. To Emmanuella, writing is living multiple lives in one soul.

Learn More →

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *