Today wey be Thursday so, dem find the dead body of one popular crossdresser and TikToker wey dem dey call ‘Abuja Area Mama ‘ for road.
This event happen early momo and na along Katampe-Mabushi Expressway Abuja e happen.
Popular Nigerian Cross dresser "Abuja Area Mama" has just been allegedly K****d by unknown persons in Abuja.
His lifeless body was found by the road side as he was allegedly beat*n to de@th. pic.twitter.com/vL93XPMbQ8
— YabaLeftOnline (@yabaleftonline) August 8, 2024
Josephine Adeh wey be FCT police command spokesperson talk sey na she confirm the news.
She talk sey Commissioner of Police, Benneth Igwe don order sey make them investigate the matter deep deep, so that them go understand as e take happen.
Josephine don explain give the public sey na she receive the call from the area wey e happen. And as soon as she receive the call, them arrange carry ‘Abuja Area Mama’ go Maitama District Hospital where doctors confirm sey him don die.
She still add sey them go dey drop update as the matter dey progress.