Wahala be like bicycle!
As we de try understand ourselves for this country so, na so kasala de burst left right and centre. The main gist be sey, six ACU students don kpai one of their colleague Alex Timileyin because of iPhone 12 wey them talk sey him tiff.
This thing happen for inside boys hostel wey the students de sleep. When the iPhone 12 lost, them begin suspect Alex as the thief. And according to them, wetin vex them pass no be only the iPhone wey him tiff, but him de transfer money from the phone send to another account.
Na so them decide sey them go teach am lesson come beat beat am. Inside the video wey don de travel round social media, them show as the boys the beat Alex, them use clipper barber him head, come pour am cold water for him body come use koboko beat am, as e de roll for ground na so them de beat am.
Na so Saturday morning come dem come discover Alex deadi bodi for front of the hostel o. Sey after them beat am, them push am comot for outside sey make him dey there. Na so water come pass garri the boy come kpai.
As e be like this, ACU Public Relations Officer come talk sey, no be sey wetin happen dey connected to cultist activities. Sey the school don already expel the six students wey kpai Alex, and them don hand them over to Police make them investigate the matter further.