Damini Ebunoluwe Ogulu, wey pipo know well well as Burna Boy, don make am big for music industry, and him bank account dey feel am.
But as many pipo wan know wetin been him worth, na why we do this article to let concerned fans know wetin dey shele for this area of him life.
This na some things about him first.
Burna Boy music career
Di Grammy-winning singer, rapper, composer, and lyricist don dey make wave for music industry since him breakthrough for 2012.
Burna Boy’s unique style of music, wey mix reggae, dancehall, and Afrobeats, don give am big following all over di world. Him albums, including “Outside”, “African Giant”, and “Twice as Tall”, don dey sell well well and pipo dey praise am.
Burna Boy charges over $1 million per show with the provision of a private jet, 8 cars, a Sprinter bus and van to pick his crew up, 10 high quality hotel rooms and a smoking executive suite.
His room must have Hennessy, Jack Daniels and Champagne.
He generated $15.5 million… pic.twitter.com/BNbQu0TdMs
— Africa Facts Zone (@AfricaFactsZone) December 17, 2024
Endorsement deals
Burna Boy no dey make money only from album sales and touring. Him also dey make plenty money from endorsement deals.
For 2021, him sign contract wey worth €12 million with Martell Cognac, and for 2022, him become brand ambassador for PlayStation.
Luxury lifestyle
Burna Boy personal life dey show say him get money.
Him get plenty luxury cars, including Range Rover Autobiography, 2022 Lamborghini Urus Novitec Edition, 2013 Ferrari 458 Italia, and Rolls-Royce Dawn convertible.
Him also dey live for big house wey get eight bedrooms for Lekki, Lagos.
Philanthropic efforts
Burna Boy also dey do good tins for pipo. Him don contribute to plenty causes, including fight against SARS and advocate for justice and equality. Him REACH NG initiative, wey him launch for response to COVID-19 pandemic, don dey give food and other tins wey pipo need to families wey no get for Nigeria.
Burna Boy net worth
According to sources from the mainstream media, Burna Boy get net worth of $34 million. With this, him don become one of di richest musicians for Nigeria.