At least seventeen (17) children don die for Zamfara Almajiri (Islamic school) fire wey happen for Kaura-Namoda Local Government Area of di state.
According to sources,di fire wey burn part of Islamiya school start in the night of Tuesday, February 4, 2025 and e don leave 16 children injured.
Di area president, Abdurasaq Kaura tell Channels Television sey, di cause of di fire fit be some dey sticks “Kara” wey them store for di school premises.
17 students dead as fire razes school in Zamfara | TheCable https://t.co/o5STvfLLdL pic.twitter.com/MLMOijKizm
— TheCable (@thecableng) February 5, 2025
Kaura talk sey, “ E happen for Makaranta Mallam Ghali for inside their study hall and na about 100 students dey inside.
Them been try rescue di children thinking sey, na all of them comot. Na after di fire go down before them come de see some hands and legs of di children wey burn beyond recognition.
The Almajiri fire victims in Zamfara fire buried amidst tears
Kaura continue to talk sey, then quickly bury di 17 children based on their Islamic religion wey require them to bury immediately. Them bury di children on Wednesday, February 5, 2025.
Confirming di incident, di chairman of Kaura-Namoda Local Government Area, Mannir Haidara sympathize with the families wey lose their children for di fire incident. While di injured ones de receive treatment.
Haidara talk sey, so far, him never get di full details of di matter but him dey on him way to di place wey e happen.